Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria Local Board, All board discussion welcomed. {No Official Language}
by
Mpamaegbu
on 11/09/2021, 15:56:48 UTC
Enyia!  Do you think that all the statements you are making come from the heads of our prisons?  🤷
😆😆😆 This is so off the hook! Laugh wan wound me here oh. Una see why Google translator shouldn't be used at all? Well, make I keep the translation for pocket. But wetin make me put dat thing out na wetin you talk about all native Naija languages be allowed. Na Igbo be dat but your translation dey completely different from the meaning.

Yes that's ur street and not all Nigerian street. We still get people wey dey hustle right like all men here dey try their best to work hard to receive small blessing while dey still dey learn in the process...

You no go fit just wake up dey say all the youth na scammers, I be youth and I Know be scammer so be others wey dey here. Na very disrespect be that wey you dey raise for the economy board. Yes some bad eggs dey but you saying we're scammers come be like we follow too and you know how the forum dey reason scammers.
I dey hate dat level of generalisation too myself. For Philosophy dem dey call am Fallacy of Hasty Generalisation. We nor go take sey because some people dey bad come sey all man dey bad. Dat nor good at all. I dey tell people around me wey dey always call any young guy wey dress and smell well Yahoo boy sey dem dey wrong. Until you sabi wetin persin dey work, nor call am criminal.