Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: African bitcointalk community hangout
by
Issa56
on 11/09/2021, 16:35:16 UTC
Guy-man, waiting naija do dise people? Y ebi say na oly we dem sabi?

u no go blame dem. Gee bois & gals dem dey spoil the country name anywhere dey enta to play 419, even our Africa neighbors dey all claim nigerians wen dey catch dem because na we dey sabi pass. I believe say if you pure baba God go clear wey 4 u like e clear for me from newbie to snr member. e no easy bros I dey try represent us wella to show dem say nobi all nigerians be frauders.
I'm surprised you are now saying this 😂😂, it's what I was talking about in other thread, every youths in my street are into fraud they are scammers that are bold of what they are doing for living, that's not the end I've even seen police and military men engaging in this act, I'm disappointed because I have kids that are growing up, what will be the future of our kids if all this is going on around them?
The one way happen to me recently I just commot wan go buy some one police man way dey my area come stop me say him don dey look for me since say him need my help. I come stop the guy come start to dey tell me story say I know say him na police now but as thing's be now everywhere dry say where dey post am say money no dey show na only salary him dey depend on and him salary no reach anywhere say him just dey suffer!!! Him come talk say him dey always see me dey press phone say him go like be like me say everybody now na scammer say make I come show am way say atleast if him dey do my hustle now him add am to him police salary say him go dey alright. I come tell the guy say me I no be scammer say I dey into cryptocurrency but the guy no gree him say na waiting yahoo Boys dey use cover themselves be that say anyone way you ask dey go tell you say na cryptocurrency dem dey do. D guy even tell me say anything way I want him go do am for me even if na to pay me before I start to dey teach am him say him go pay. I was even confused because I don't expect that kind of person to come and meet me for that kind of thing. I told him am not a scammer that am into cryptocurrency and if he is interested I can teach him, but he was not still satisfied with me teaching him cryptocurrency he just want to learn yahoo. I told the guy am not a yahoo boy and I left.