@Nathrixxx I just wan advice you, no dey just copy padt articles everywhere as e dey very annoying and your mata don enter our boss lady hand, if u no stop and she continue to dey report you I believe dem go ban you like temporary or maybe delete all ur posts self as did type of post dem dey call am low quality no mata how e long reach.
.

At least from time to time we suppose de find gist we de glorify our own hardwork as Nigerian too put up here. I go like us to de celebrate ourselves more than the nonsense those selfish leaders de do us.
God bless you broda, lizard on e own dey tell himself say e try after every jump, if e no praise eself nobody go reason am say dat distance e jump high. I like wetin you talk wella, make we dey share good thing about bitcoin and other stuff for this forum as e go increase our chances to get local board.