Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria Local Board, All board discussion welcomed. {No Official Language}
by
nelson4lov
on 20/09/2021, 21:47:19 UTC

~Snipped

Lol, guy our country don jogodo oo if nobe this place I wonder how someone of us for dey take survive for this year country, na so so borrow borrow I dey see for news daily, dem mate dey invest in Bitcoin for the future dem dey here dey borrow, na only political situation matter to dem, no more economic talk shows, everything is just complicated for every corner, na so things too dey cost anyhow

Bro I just tire for the country. I no even know the direction that the country dey head to but e dey look like doom to me. Everything just dey go haywire. Prices of foodstuffs and almost everything don almost do 2-3x increase from the initial price since this Buhari government come in. At least, all those people wey been vote Buhari for first and second term for some cups of rice dey follow us suffer for this country so next time them no go sell their votes for N500 or 2 cups of rice.

Naira dey on steady collapse. Oil prices continously dumping. If nothing is done soon, country go collapse.