Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria (Naija)
by
Smartvirus
on 11/10/2021, 22:11:03 UTC
Well done my country people e take me time to fit find una for this place. Why we hide here na anyhow sha I thank God say I don finally bsee my people. I nor too dey active for here but as I don see una so believe me I go dey enter wella. My calling na to dey play chess na my favorite thing for the world be that. Anybody way sabi play here make e send me message make we connect for LilChess
I buy my first Bitcoin this year as I see how much those boys way get Patricia dey make.  Now I know say something dey special about this Bitcoin something
 Username: KarpovE4
Gender: Male
Skills: Chess Player
You do well to don show here las las and e go sure say, we get another person, one of our own way go help carry thusbolace up. Brother, I no ho tell you say e easy for here but, I go say make you dey do that thing way come from you and be you. Na that kind time you go con dey enjoy the life. When you go dey use to the forum, outside life go tire you, e go be like say you go holiday but, na just to ye you say, e don turn  lifestyle and no be hustling o.