Also I go like add say the posts where person go come dey check up on others for the this board no dey necessary I don talk am before say e dey make the board in all round look like sey e be a chatting forum, rather you fit ask about person wey get issues or person wey it's confirmed sey something dey happen to am, but e go dey very formal, make we no use sey we one talk for this board come turn am to something we no go dey proud of, and newbies wey dey join us, I believe sey we get a partner of introduction, make una them dey try follow am e dey make everything get better packaging na my humble yarnings be this.