MBA forex was never trading.
If this mata come out to be like this I no go get doubt as every business for Nigeria today na Ponzi even the banks, dats why dem dey restrict withdrawing but allow deposit to any amount. Dem dey carry Paul money pay peter but in a more legal way. Well MBA just need to bring out proof of them actually trading and the whole ponzi accusations go drop. Trading no dey hard for pros dem. Dem fit make all those billions actually trading. Make we no just conclude although all possibilities dey say na Ponzi dem been dey operate.
Are nft is not risky?
Very very risky, the NFT wey legit dun already cost and I just discovered that about lands dem too as I begin research to buy land for metaverse. This ones wey cheap fit no worth anything again. That's your money fit just go. To buy NFT or land, you go need make sure the project legit and go dey around for the next minimum 5years because we go need another bull cycle for this sector to strong.
No go invest with all your savings as nothing dey certain, just put in chicken money and if e go no problem but if e blow, ur luck. See ehh new trend go always come so no feel say you miss out. The only thing I fit advise now now to dey secure USDT as buying opposite go present itself soon for the market.