Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria (Naija)
by
Smartvirus
on 15/12/2021, 20:42:48 UTC
Bitcoin or naira, bitcoin is falling

Price of bitcoin as been sinking down, I put money inside from naira, my money is decreasing small small, I am afraid, will bitcoin continue to sink down? Shall I take my money to naira? It is like bitcoin is falling down, will bitcoin continue to fall or naira is good?
When you dey talk naira, my body just do me like say, you dey reason before to cash your btc back to naira then, you go live am for bank account or you go live am for any platform way list NGN. That for be big error o. Via say, na NGN fiat wey dey use for this side no mean say, we go dey trust am and ecf, e no suppose dey turn up for online matter cef because e no follow. Naira no function as stable coin dey do. Naira too dey fall and na so the lose you been wan avoid dey count kwa. No dey reason naira, you fit try USD but, forget naira for this kind matter, e cast.

Though, that conversion to stable coin, e no too sure now for me o because, e be like btc don fall finish con enter ranging market. E go climb later buy e fit take small time. If you convert now, you fit dey loose. Na when e dey up, you for convert. That na if you plan use am buy again when e go dey down like this.