Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 1 from 1 user
Re: Nigeria (Naija)
by
Mpamaegbu
on 06/01/2022, 10:13:13 UTC
⭐ Merited by Pokapoka124 (1)
If we get that person reach 5 for this place we for dun get strong case instead of the English wey they flow here. If you dey use chrome to understand wetin e dey write e no hard na Yoruba. I prefer other languages than English because na strong case for us be dat. To dey read things for English just tire me here.
Na true wey you yarn here. I nor wan go back again to the back and forth wey happen here unto the kain language wey we supposed use here. I'm all for any language here, except English. I nor get any ish with vernacular at all. I don even post one time for dat Yoruba thread with d little Yoruba wey I sabi 👇

Waawu! O ya mi l'enu l'opo l'opo lati ri wipe ede Yoruba ni aaye oto l'ori website yi. Inu mi si dun sii gidi gidi ni. Nje a ri eni ti o le fun mi ni merit? Inu mi yio dun gidi gaan ni. Ese pupo pupo...
Kilo je "Waawu" nibiye? Shey nyi je ijile ede Yoruba ni? Mo ro kpe ede English niye.


However, d ish wey I raise na d use of translator. I sure sey I don read am here wey some DT members frowned at it. I nor fit trace that thread now. But persin nor supposed dabble into wetin im nor sabi handle in order to deceive others na.