Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria (Naija)
by
Sandra_hakeem
on 20/02/2022, 20:33:07 UTC
Quote
Another thing wey person fit talk na say e be blogger, talk say you dey write articles for publishing companies,
-nor follow dem smile at all,
-nor too dey talk plenty things or answer many questions cos na so dem dey take find wetin dem go use hold you. Just talk Wetin you know and keep mute the others,
- Do not agree to enter their vehicle, if you mistakenly enter their vehicle, money must comot your skin before dem go leave you.
I pray no one here falls victim to these criminals in uniform, cos shishi nor dey to give dem.
This Tori wey u yarn us na true ooo but wat if these olokpa dem still insist make them see your blog or website wey u dey run the adverts nkor? E fit come turn serious issue Las Las becus I don dey that kind scenerio before wey ( na military them run this one) them tell the guy make him sidon for main road,open him laptop but him no gree ; na so dem wooze am slap for eye then push am till him fall then them force am to check him laptop, it was very appalling Undecided
My own advice be say; we get app wey dey freeze other app for our phone and e get as u fid still hide am for this new cal. App wey fid hide other apps; so that u fid just select ur sensitive apps them, freeze them there then unfreeze them from that place whenever u want, to avoid the embarrassment. Na just my own little opinion be this ooo, una Weldon