My people, I greet una.
E don tai way I com dis side o or evn cef, 2 dey day active 4 d forum bt anyhow e be, I remain Mr.right85 nd I don show back. I wan dey try 2 dey do as una dey do bt, e no easy 4 me at allll. Dem say watin u no sabi, e big pass u and as by d gud tin there be say, u fit still learn am.
Here sure for you pass na unto say local posts no be problem for the campaign weh you deh. I no come know wetin make you no deh frequent here. Na the same campaign we deh. Anyhow weh e bi e go bi make you deh show face here now well well as e go help your people deh sabi you well deh go.
Take your journey in this place very serious because the benefits wey follow too much ooo
No be lie you talk. The benefit yafuyafu. But na for senior men like una e sure pass for. Me self I deh imagine wetin I go deh do with that kind weekly pepper weh una deh get if e touch my hand. Na real enjoyment una deh.