Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria (Naija)
by
Maestro75
on 25/02/2022, 10:42:44 UTC
He ignored all the advice. Cookdata bring him matter come here make he correct am him no still hear word. All of us na newbie once upon a time, I don make mistakes too and I don face the music na with that experience we take dey advice newbies but sometimes newbies go dey see am as nothing until he go happen. I nor dey surprised about this account make others use am learn. Those newbies way just enter forum dey create 10 topics once for b&h I greet una

edith1995 say na she weh she bi, you deh address am as he. You want to turn her to Bob abi another Jubril from Sudan? Make our people deh try take advice small small but them no deh like listen. If people weh deh somewhere before you warn you of something you supposed listen to them.

About Ukraine and Russia war, na still people go die las las as people deh die everyday for Nigeria with wetin boko haram, bandits, unknown gunmen, kidnappers, deh do on the normal. All die na die.