All of us dey talk one thing, but Charles and Igehh dey reason like say dem no dey dis we country. Dem dey talk like say dem get right base on wetin CBN put for book. Wen you Don fall victim na em you go know say the fight na between government and the people.
Me and my guys don make some dangerous waka for Ph to dodge police, based on say dem dey search people phone to check who get Binance or any other wallet for phone. Say dem ban crypto for Naija. Dem capitalise there suck people dry.
We go need to know say our government dey rape us everyday. The reality be say government no even understand wetin dem put for paper.