Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria (Naija)
by
Wiwo
on 03/03/2022, 14:27:07 UTC
Na which level ? broken or english ?!
English, Pidgin and local language all dey accepted. But if no one reply to your local language post, no vex. According to past arguments and opinions, we concluded English and Pigdin dey accepted as everyone dey understand both. According to poll, the three (English, Pidgin and local languages) dey accepted.

But enhh my bros, if you look am well, if we dey knack English this mehn go dey understand wetinn we dey yarn. Omohhhhh e no go well, u no go fit go understand wehtin Dem they reason for another local board, why we go come they speak english ?
We gas dey on our guard ohhhh, after all nah privacy privacy I just dey OBS since me I lap this unit.
We gas dey on our widas ohhh!!!
I know say dis matter of language go still come up as the thing no too straight 4 most people, but as e be say people don vote b4 sake of the language we go speak hear me go rest on that matter, but me know say language na him be mega thing were don hold us make we get the local board. The matter for easy if to say we fit dey speak one language and as e be so make we put body for pigin since were be say na him most of us fit relate wella for pigin. Make una no vex say I still talk on that matter make una 4giv me, but make we dey try write 4 pigin for we thread to dey make sense 4 only us 9ja.