What we need na activities and quality posts regardless of the language used, stop to dey focus on what is not. Accepted languages na English, Pidgin and local languages. Make you stop bringing this up again and again after statistical conclusion that favoured all languages for Nigeria. I will not post about this again except when dey necessary, we all know what is officially recognized.
No vex say de matta of language no gree enter under carpet. If you use elder eyes look the matter you go sabi say e no fit enter carpet. Anytime any new person enter here, the person go still bring the matta up. Even when me enter I talk about the mata too, before I come decide to follow up with wetin dey wen person reason me say the mata don dey settled.
For the translator wey you talk, na oyibo develop am. If you get opportunity to develop your own, I know say you go develop pidgin own. Them say na necessity na em dey bring innovation.
If you be content writer for ph and warri where your audience like pigin, you go write content for pigin too. Me I dey read content for pigin wela for BBC pigin.
So, as the matta be, if pigin dey hard anybody, make de person use correct English join but make majority try use pigin. According to Wiwo, e be like say language follow be we problem for getting our local board.
When I be member, I write
post for beginners and help and interpret the post for pigin put for our board, many of us here no do like say dem see the post talk less of to appreciate the post. Na few people wey shake body. But na that kind thing we suppose to dey encourage for here shaa.