NEW TOPIC: Politics and Cryptocurrency
For many countries like my own (Naija), general elections go happen next year (2023). Politicians don dey make their underground waka, some done dey jump from one party to another, some don dey talk the positions dem wan occupy. But, we wey sabi crypto, e be like politics no concern us. No mata sey we get brain pass dem, but we no gree join for politics.
If elections finish, our eyes go clear when people wey hate bitcoin and crypto, wey no too sabi money mata go become our leaders. Them go begin sama law wey no go favour bitcoin, like to ban it. We go return here begin cap say government wan kee bitcoin. Na who be government? Na we, but we just leave am for others to run.
Me I don gather mind to run for my ward councillor, I dey popular and my people trust me but na money dey yarb man.
I dey beg una to try put body for politics for full or use money support candidate, make people wey hate bitcoin no become leaders come put laws wey go affect our wealth. Me and you fit still be government.
Translation: