Dis new thread dey self moderated to prevent spam and scam like activities. I promise say I no go misuse am, e go only come into use when na for the betterment of the community.
Ma people I greet una oh, this thread wey I create like dis na for we to come together gossip, laugh and enjoy things wey dey happen for dis cryptocurrency industry wey relate to us or affect us directly. No shy here oh, just dey free discuss everything wey you get for mind for here, if you get any questions we dey for your mind, just ask.
Make we just try our best to obey every forum
rules and regulations and only legal activities go dey allowed to function on this thread.
NOTE:[1]: No go dey trade with another person you just meet for here unless you trust them and all trade related transaction, carry am go
Marketplace board and child boards for transparency.
[2]: Official language Pidgin (Local dialect dey also welcomed).
[3]: First timers abeg just introduced yourself so we fit relate weller
- Username:
- Gender
- State of resident (optional)
- Skills (Dis one dey important oh incase person dey find person like you we fit recommend)
.
[4]: if you wan start new topic, abeg use dis format: [/list]
[b][color=red]NEW TOPIC[/color][/b]
then you gist us wetin you get to talk.
Example:
NEW TOPIC: wetin be your experience for dis forum so far?.
Constructive suggestion they welcome in order to improve discussion wey dey go on for the thread.
I sabi everything wey concern how to buy and sell fuel for filling station and I be supervisor for one filling station right now inside port Harcourt, in case you need fuel na wey be say fuel scarcity dey everywhere, I feet be your sure plug.