Una see that thing about greed and shamelessness. See this ex-footballers weh we think say go even deh on the part of the youth don sell themselves give Tinubu. Kanu and Okocha deh there self. Ikpeba shock me too. See as that one called Taribo West deh vibrate there say him deh pray. I sabi say them get right to their choice of politician to support but na with old cargo like Tinubu? This is shameful. Men supposed get class and shame na. See picture of their meeting with Tinubu and the video of Taribo praying below.
I dun yarn my mind for that our NFPL thread, you see this our hero footballers dem Sabi fall hands. I no know weda na because during their time money no too dey so now dem wan cash out by any means. You no fit see the recent footballers mumu like this. Another person wey e mata dey tahya me na 2baba. That guy's sabi lick yansh like monkey. Very soon na you go hear say e wan organized protect for youth den as soon as dem wire e AZA, e go just go offline.
For me na dem falz I dey listen when entertainer dey talk about politics. The rest na either money or family affair. We go just dey here hear say tinubu dun win, e go just do us like film. That man dey set e compass loudly and for Nigeria na gra gra people dey win election oh even though the main person slow like buhari, provided e get gra gra people wey day e back, na sure tickets.
Wetin you yarn here na better yarning as e be like this eh me I no fit carry my money go listen to any musician wey say em dey do show if e no be davido and fals. Davido dey help youth them for empowerment unto say em get money em no dey beg like some people wey dom enter studio na wey campaign dom-start dey use one old cargo name dey do praise and worship for em to rub them oil for mouth, fals dey follow em papa wey be falani step as em papa no dey support wuru wuru people wey dey collect wetin no be there own for our obodo naija so em so fals dey vex, the guy dey use em music take dey blast our politicians wey dey do bad work and dey ones wey dey chop money for project for inside naija. As e be like dis now, dey wey dis old man wey dey claim say em be youth (Tinubu) take dey waka waka for dis em campaign eeh if no stronger person wey em face show come out come challenge am eeeh tinubu go win and our suffering go pass like dis for naija. Na only him dey waka dey meet people wey em feet say go herep am win and person wey wam win election na dis kind tins dem dey do.