Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria (Naija)
by
GiftedMAN
on 28/03/2022, 22:54:32 UTC
My whole advice to every Nigeria for this coming election wey wan happen for 2023 be say.
2023: Don’t die for dia wars oooh. All politicians be friends. Buhari, Atiku, Tinubu & co are all friends. If you no see that at his son’s wedding, you dey on a long thing.
Be wise and vote rightly in 2023. No go kill and dull yourself for dia matter
Very good advice. But me sure say nothing dey sup, youths no go kill themselves for election. The ones wey go do am na mumu youths. End sars protest don really open youths them eyes for this country.
Secondly, plenty youths both the ones wey wise and the ones wey no wise don join street, and dem dey collect, many of them no go because of peanut money carry gun for those wicked politicians again.
As you talk this thing now, make we try promote the campaign. Dem no create youths create thuggery and then create old men create leadership.
I wish say all the youth go get this kind sense wey you take to drop this message walahi e for sweet me well well because if all the youth pipe low dey maintain for the hustle wey dey give them joy where our politicians wam see them talkless of to give them peanut money and guns to take cause wahala? Na some youth wey dom use ice and other hard drugs kill them self finish go mumu go work for people wey go later come kill them finish. I just pray say make them use things dem wey happen before get sense.