Toh ASUU don officially renew their strike bundle to original 12 weeks dem say the committee wey government put together never call dem even for once for meeting since February. Another thing wey dey pay them again be say politicians dey spend hundreds of millions for next forms and other things like say Na biscuit dem dey buy, and none of them don put mouth for any wey concern public universities. Dem fashe everything like say so dey exist for Naija again.
Personally for me ba this thing reach man make he cry. Imagine people wey suppose dey represent us dey carry us play ludo.
So my people how una take see this ASUU strike renewal
Make Nigeria Students body go close all the private Universities. So that the Politicians pickins sef no go go school. Nai be the best way. When the private Universities edon close. Den go answer ASUU. If not Politicians now dey concern only for their next year election.