Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria (Naija)
by
Bamjos
on 11/05/2022, 13:49:41 UTC
Username: Sacrod
Gender: Female
State of resident: Kwara
Skills: Data analysis using STATA and SPSS

I just joined the forum last week, na person hint me sey make I scroll down, I go see this part of the forum where I fit relate with my country people. I never sabi plenty things as per JJC wey I be, but I dey ready to learn from people wey get experience pass me here. I'm happy to be here.

Another JJC don lap the unit, e con be banny again  Wink. You dey lucky sey you locate this place on time, person like me, na after 3 months wey I don dey forum dey wonder like children of Israel, na in I later locate this place. Make I cap you wetin staylite dey cap fresher for here. Make sure sey you no do copy-copy, no even try am, if you go copy anything at all, make reference to the original person wey get wetin you dey copy.

And our Elderly ones for here dey very generous, in case you dey find anything difficult for forum, no dey shy to talk for here, the Agba-Awo wey dey the unit go reason your matter and help. Last last, make sure sey you dey contribute to this place, na your father land inside forum be this, do well, and your future go shine Grin

Welcome!