Username: Sacrod
Gender: Female
State of resident: Kwara
Skills: Data analysis using STATA and SPSS
I just joined the forum last week, na person hint me sey make I scroll down, I go see this part of the forum where I fit relate with my country people. I never sabi plenty things as per JJC wey I be, but I dey ready to learn from people wey get experience pass me here. I'm happy to be here.
Welcome sister. E go well as you join us here. For few months now many new people don dey join us here and na good development. E go good well well make you understand the rules and regulations wey dey guide us here and apply all of them. As you don come, you don come finish, we no go wan lose you to plagiarism. Try understand plagiarism well well and avoid am abeg. That thing na serious offence here. I see where Bamjos tell you about it.