Toh ASUU don officially renew their strike bundle to original 12 weeks dem say the committee wey government put together never call dem even for once for meeting since February. Another thing wey dey pay them again be say politicians dey spend hundreds of millions for next forms and other things like say Na biscuit dem dey buy, and none of them don put mouth for any wey concern public universities. Dem fashe everything like say so dey exist for Naija again.
Personally for me ba this thing reach man make he cry. Imagine people wey suppose dey represent us dey carry us play ludo.
So my people how una take see this ASUU strike renewal
If person dey wey this country matter don tire, aswear na me. To me, na both government and ASUU no dey do well, even if we sey politician dey send their pikin go private school or abroad, ASUU executives self dey put their pikin for private schools and some bin get pikin wey dey study for abroad too, so this whole matter na like two elephant wey dey fight, na the grass wey dey where dem dey fight go suffer. Both ASUU and Government no get any concern for the students, na why e easy for both side to dey do things as dem like be that.