Post
Topic
Board Other languages/locations
Re: African Proverbs in Pidgin
by
Mpamaegbu
on 14/05/2022, 04:55:12 UTC
@uchegod-21 African proverb no get only one interpretation or meaning, you feet get another interpretation while I get another one e feet no make sense or point to the direction wey you expect but look deep inside the talk you go understand well, proverb na words of elders no be something wey you no go reason well before you understand.
uchegod-21, dey perfectly correct for dat analysis and even with d example wey im throw take join am. I for still baff you as I baff am for ur attempt too, you try, but na my last bucket of wata I pour am so. Wetin you go talk for owa African proverbs be sey different proverbs fit mean one thing but nor be sey one proverb fit mean several things. No. As dem dey talk for Igbo sey different tribes get different ways wey dem dey take laugh. Na so d thing be.

I salute all of una wey dey continue to push dis owa corner here. Na real tight corner be dis. I believe sey d thing dey improve owa yarns with elderly people wey sabi proverbs too. Chinua Achebe sey proverb na d palm oil with which words are eaten, quote and unquote.