NEW TOPIC: Nigeria Local Board Thread Monthly Appraisal My people, I start this topic for this our thread to help motivate us to dey contribute wela here. E clear for our eyes say we dey hustle make theymos recognize us and give us our own board. Then, no body sabi the criteria we need meet before we get our board. But for sure sure, increase participation na one of the criteria.
First, I wan thank us, we don increase activity for this our thread. When I come here new, e dey be one or two persons dey serious for here. But today, plenty people don join body and plenty new people don show too. I say congratulations.
This topic I go dey drop am here immediately Rikafip drop him monthly update for Meta. This my own na to show us how we perform individually for every month here.
I get
1 merit reward for anybody wey top the list every month.
Make 1 merit no small for our eyes because me no be merit source but I go find wey to reserve that 1 merit every month. Anyhow wey e be, na appreciation and honour. Other senior men here wey like the idea go fit still sponsor the idea based on the merit thing.
I drop March and April own make we see how we take try:
FOR MARCH Observations- Charles-Tim dey try wella as na him top for the month of March. Him na man wey sabi post for here even when him campaign no dey count post for local board. I comot cap for you.
- Maestro75 na regular name for our local thread. Him and the like of Wiwo dey always give their best when e come to dey contribute for our local thread here
FOR APRIL Observations- Maestro75 post highest for April, you dey do well, keep it up
- CryptopreneurBrainboss don dey consistent for this thread since wey him come back with full force. I hail you sir. Keep trying
- uchegod-21 na person wey don dey consistent for this thread, him no dey top as number 1 but him dey always dey among the top contributors for this thread. Keep up!
- Another observation be say Charles-Tim drop hands well well from last month, I no know wetin sup. But I know say him go pick up again.
- Wiwo also drop hands, I no know weda na him new born pikin cause am
- Igehhh kuku comot for the list totally. E fit be say na when him dey work on his Services launch. Now wey him don launch, him go come back full.
N/B: Make we try go comment related things for him thread, atleast praise him small there. Naso these things dey work, e go help keep him for first page, serve as cool review and also increase him view. I dey go do my own now. - New names like Marykeller and Oluwa-btc face dey show small small, make una put more efforts. Person like Davidvictorson don appear for the list. Keep up!
- Other senior men like BIT-BENDER and Coyster dey try consistently. SatoPrincess dey try but you suppose try pass wetin you dey try now.
Fellow Nigerians make we continue in love and unity, the future dey bright.
Thanks to Rikafip for your wonderful thread.
uchegod-21