4 secondary school, them tell me say we go be the leaders of tomorrow.
Now we weh be leaders tomorrow, tomorrow done reach na our ancestors still dey circulate the power.
Omohhhhh e no sexy 4 9ja, 9ja no be for the weak, politics nah your mate ? Wahala for who no bow for Nigeria ohhh.
Belike you dey forget easily say school na scum, no dey believe anything wey dem tell you for school if not, you go just useless. Go school oh but go am with sense, understand say real life no be school life. U dun forget say school tell us say immediately we study get good grades and pass well say we go get better work, how far. Since how many years now graduate dey jobless upadan. Dem tell us say we be leaders of tomorrow when the system dey corrupts wey be say before you even get chances to be the leader, you dun become grandfather too.
Naija na just cruise, go school to learn and get a skill to earn. Now if you understand the way forward you go know say na digital skills be the 411 and now blockchain just add spices to am. Get skills wey relate to blockchain as soon the whole world go need skillful professional from the sector to put them on and better pay go dey involved.