NEW TOPIC: Nigeria Local Board Thread Monthly Appraisal Observations- Maestro75 post highest for April, you dey do well, keep it up
Ope o! So I finally carry golden boot sha. Make I go find where I go buy chilled bottle water to celebrate am.
My brother your hand clap, your shoe shine and your face show. You be one man wey dey always dey here dey contribute. You dey try no be small and you deh dey objective for most of your posts dem. Remember me if you dey chill with your beer. That bottle water you put there na camouflage.
My 9ja people, I hope una deh see wetin deh happen for APC at national level. Tinubu frustration don begin make the grandpa begin run mouth anyhow. E don clear for him eye now say Buhari no want to give am opportunity. Make we deh watch whether him go jump comot for APC or remain there. I like wetin deh happen to Tinubu.
My brother, if say you dey follow my political post here, you for no surprise for wetin dey happen to Tinubu now. Tinubu himself know say na so e go happen. Na wetin make him DG decamp tey tey to go soften ground for him for SDP.
Na on 7th June wey Tinubu suppose defect, unless something else play out.
For Buhari anointed candidate and consensus. As of this evening, na two strong candidates them dey debate.
OSIBANJO and APC governors Vs Amaechi, Buhari and parts of APC governors.