Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria (Naija)
by
Adbitco
on 05/06/2022, 01:15:14 UTC
~snipped~
So, you even be my cowtri man sef. Nice wan comin to associate with us here. Finally, owa guys are coming back home. E get wan other user wey be "naira" wey I don sight. From d username may be na owa persin too sef. Anyhow wey e bi, ogoro must jump. I greet everibodi here.

Hehe 🤠 no reason am oo..
Evil plenty for this industry o if man too do them go humble pesin like this so I say make I go village go relate with my village pipo maybe after everi thin I fit show back. Anyhow me dey see you too but na eng. Ighh and brainboss pay my tp come back to village na so me carry bag come back home say make i relax.
A big shout-out to them @Igehh @Brainboss na so e supposed be say if monkey go market e no return the owners go find am go market carry am come back house 🏡 na so them carry me come back home as well.
Somehow I dey give charles-Tim green light but him dey see me as threat so I no too gum body were him dey but I believe say from here him go know me wella.