@Zlantan. Guy you for try find somewhere open thread on top this success story for forum. I check your post and this story no open any thread. The story dey inspiring. Although na we naija the thing teach something more as this government dey us on top bitcoin ishe.
I been want say where the link dey to go read am before I come see where you touch light am put. Nice info bro, I give u something dere.
Make we no mind this our government people, na personal pucket all of the thieves dey find. Asuu still dey dere oo but na to buy form and step down and collect money from sabi. Na business Dem dey do with 100 million purchase of form. You buy form with 100 million and step down with more millions, which kind business pass that one within 2/3 months. See ROI on investment sharp sharp. Chai naija, country where the rich dey hammer more and the poor dey suffer more. God help your people.