Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria (Naija)
by
SatoPrincess
on 11/06/2022, 20:01:44 UTC
Politics no be here oo, this we country tire man but anyhow e be make we try our best to carry we legs go enter were we go do PVC make we vote out bad governance.
Guys how far, with the 2023 elections already on us and we already know the front runners, Peter Obi (LP) Tinubu (APC) Atiku (PDP) this are not the only candidate but them be the three major candidates we have now, so guys we don see how the present administration done treat crypto-currency and really e no bam at all, so now for us Crypto-currency enthusiast which of these guys do we think wey fit put interest for crypto-currency, these men aren’t youth so that criteria is aside, but my honest opinion now with education, business knowledge and other qualities I think amongst the three Peter Obi is most likely the one.
My circle dey full of young people way believe in Peter Obi vision. This election go be one to remember for Nigeria history. AFAIK this na the first time, Nigeria youths dey fully involve for politics for good reason with bias of religion or tribe difference. If na before, them go say Ibo man no go fit rule the country but now we no send them with that story again. Make the most qualified person get the position. Tinibu and him people go don dey plan how to rig election