Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria (Naija)
by
uchegod-21
on 11/06/2022, 22:32:40 UTC
Politics no be here oo, this we country tire man but anyhow e be make we try our best to carry we legs go enter were we go do PVC make we vote out bad governance.
Guys how far, with the 2023 elections already on us and we already know the front runners, Peter Obi (LP) Tinubu (APC) Atiku (PDP) this are not the only candidate but them be the three major candidates we have now, so guys we don see how the present administration done treat crypto-currency and really e no bam at all, so now for us Crypto-currency enthusiast which of these guys do we think wey fit put interest for crypto-currency, these men aren’t youth so that criteria is aside, but my honest opinion now with education, business knowledge and other qualities I think amongst the three Peter Obi is most likely the one.

Some politicians wey their money too long no dey like make other people see road so that dem no go fit compete with them for anything. Those kind leaders go fear to give crypto free hands. Dem believe say if youth see raod, dem no go fit influence dem with money again. Person like Atiku and Tinubu no go give crypto free hands like that. But Peter go give free hands because na welfare of the people wey him want and not his personal gain.
But if people organise summit give Atiku, tell am reasons to allow crypto him fit listen because him dey claim economic and business man. But you see Tinubu, I no sure atol.