Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria (Naija)
by
Adbitco
on 12/06/2022, 07:28:22 UTC
Username: cantsay
Gender: male
State of resident : Edo state
Skills: graphics design, web developer

My people I greet una Wella oh, nah first time wen I dey see this thread be this ooh I nor know say my people dey this forum with me. If to say I quick know I for don come greet una since na, I throway salute for everybody.

Anybody wey dey for naija when don reach to do PVC and the person refuse to do, make that person just know say he/she na part of naija problem.

Omo my brothers pesin wey I know na Peter Obi, I m not just voting for party but credibility and someone who will enable us enjoy all manner of free access to crypto currency transaction, I m sure Peter Obi understand how we got funded during end SARS  protest and all this came from donation through BTC and other cryptocurrency so if he's going he should know that we must have full access to blockchain.
So I believe he will know the pains in youths and why he is there representing us.
I cast my vote to PO.
I'm OBIdiently waiting for 2023 to ensure that the LABOUR of our hero past is not in vain.
Abeg my people, how person when nor fit stand give speech go say he wan lift full country up? That one dey possible? 😂

Abeg for those of us when never still go collect PVC abeg make we try go collect, do am for yourself and your children (both born and unborn).  Once again I salute una.

Make una nor mind my text formatting I never still Sabi am finish nah learn I still dey learn am.


First of all, welcome home feel free to yarn anything wey you wan yarn but know say here we no dey run street, here we no dey do something wrong, here we no dey ask pesin for back to collect money after every you tuamma that one go really spoil our name for industry. I go say no even reason one day say you go play smart run pesin street, because all the blame go still land for we head so anytin you no understand just ask am here ur broda's dey here to help you get am correctly, even though you wan make post abeg no go copy for www carry come post or else them go knock you down quickly so like this try make your own personal write-ups. I know say you already know the umbrella name for we 9ja pipo, so no just make pipo wey dey the industry believe say all of us na the same or say na everybody no dey Legit.

Again welcome to your Broda's.