We don pass the era of casting our vote for party na who know wetin he dey do na we dey vote. As Peter Obi change party to a party way no too get popularity like that I like am. If he win e go show say no be party dey make presidency na the people dey in charge of democracy.
Dat na if e win o nd if e no win nko, u go agree say, na party dey run am abi... bcus, e be like say na so e be 4 we kontry true true. Imagine election way candidates brekete 4 ground, na onli 2 pple way plenty pple dey see say, if no b dis persn, e go be d orda 1.
Na so e bad reach, na party plus moni. U go dey imagine say these men dem go jst dey tell demselves say, na my turn to rule. Dat kind tin! Dat na to tell u say, votes no dey work anytin 4 d electoral process again. Na straight up pay nd carry. Na moni dem dey use buy d chair now. Mak dem no just sell d kontry 1day shah.