Notin spoil your face show and your shoe shine wella.
dis place na only secret room wey we dey meet every day, every time and any moment. No too see here as place wey hard to survive but i go tell you say e dey very simple if only you ready to understand how the forum dey work first before putting mind to make am from here. First, i thank God say you just finished your first Degree meaning say reading blood and pressure still dey your DNA, abeg also use small time go 2ru few pages from here you go see where me
explain how the forum works at least to refresh ur brain small before you go post.
Secondly, your account dey occupy with bounty activities and e go dey hard for you to grow bicus dem go see am as bounty account and might get ban if dem noticed unnecessary activities from the account, so is either you stop bounties and delete all those bounty reports from your profile so that people fit look into ur account and reason ur mata to help you grow.
Lastly you fit stick around here make you see wetin dey happen and how you go carry make movement onto say anytin you no understand you fit ask am here, nd no go argue sometin wey you no sabi or dey see urself as pesin wey know everytin if not menz go leave you alone o, i hear say pipo from your field of study sabi argue sometin too much. But anyhow no reason am na just advise and our pipo say "Advise no be cause".
Once again welcome!
Goodluck