After I read this post finish and the way Fani Kayode wey be confirm Nigerian Political Psychopath dey criticize PDP and NNPP northern tickets, I come dey tink say wetin him for dey call Tinubu now if him still remain for PDP. If we remember say Fani Kayode na PDP turned APC becos of belle since work no also dey. Our politicians no get any stand na so dem dey support where food dey come from.
Since FFK bad mouth Buhari and Apc finish still come join the party, I stop to dey see sense for any thing wey come out from em mouth because I see am as person wey no get integrity at all. For the talk wey em dey condemn PDP and NNPP for northern person wey dem give ticket, I see am like person wey no get beta thing to yarn because em never comot wetin dey em own party eye em come dey put mouth for wetin dey other people eyes. That man no feet mention tinubu name because if em tryam dem go comot food for em mouth for Eva.