Our politicians no get any stand na so dem dey support where food dey come from.
Na business venture for many of them, game of interest. My joy na say those days when e be say many Nigerians go just dey follow blindly wetin these our politicians and people wey call themselves our leaders dey talk dun pass. These days, the majority know better than to trust most of these politicians especially the old ones.
Na d legit u dey talk so o. Politics na full tym game of interst nd na so u go dey see politicians no dey stand on der word, dem go talk somtin 4 one side and d nxt tin, dem don jump go wher dem feel say, e go favor dem. Na dat tym dem go fine one statemnt 2 use revise d talk.
Naija pple don tire 4 al dis kind tin. Our development con b d once way dey push us backward. E con b like say na d developmnt dey bring us suffering, abi na so e suppose be???
No naw, dat tym way pple dey jst leave politics 4 politician hands dem don pass. Evn if e no sure 4 d pple now, tym dey cum wen, we go dey reali decide our leaders nd wen dat tym cum, u go see say, politicians go dey do well. No b jst 2 dey share rice during political campaign.
Politics for this our kountry na for stomach infrastructure anywhere the money go come from make Dem just dey thief am. Them one finish the country but God no go let them