Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria (Naija)
by
Davidvictorson
on 23/08/2022, 07:39:11 UTC
Make I put mouth 4 dis talk. Politicians dey play prependal and premodial Politics, Di game of interest sef dey nd y Dem no dey stand 4 dia promise bi say na di masses nai cause dat one. Di money wey Dem dey spend give pipo dey hv 2 getam back 2 pay dat debt den anoda won bi say. Political sponsor (godfatherism), mostly in Bayelsa dis na di problem we dey face. Bayelsa State allocation is bigger Dan d total number of population. Bayelsa e get about #2m pipo den di money wey dey enta di state na #16+b tell me where dis Moni dey go. Na d catel dey sharam nai make wen election come Dem dey spend billions 2 bi elected. And di foolish youth go collectam. Di restoration team in Bayelsa na di main problem in we state.

Nai make if di pipo say dem no go collect Moni 4rom any Politicians nd vote without bribed den di so call politicians go reposition demselve. Di pipo dey cause everything

I believe say the person wey talk say politics na dirty game dey refer to Nigerian politics and politicians. Most of our politicians na political ashawos. Na just political prostitutions dem dey do. From FFK reach Umahi, reach the other one wey don dey run for president since I dey dem stop to dey sell N5 bread. But wait o, this same politics and politicians wey we dey bastardize some of us sef nor better pass them o. Common classrep, Faculty and SUG elections, we sabi how we take run am. So make we take am easy with all these bashing nor be we holy pass Grin.