I greet all the elders on this forum, una boy dey hail o, Ekale, inauni, ehihe oma. Glad to be here.
Oga Leo, e be like you wan set us up o...
You carry account wey start forum together with Satoshi enter come dey call people here elders. For here, elders no be by age o, na people wey don tey here gather experience be elders. So, you self na elder. Very big welcome and I believe say your ride here go go well.
I take style check your post history, e be like you dey post for areas wey no dey too visible for the forum. E go make sense to dey post were men go see you and send merit give you. Your name sef too sweet and e no suppose hard fly for the forum.
Thanks boss, you na agba o, me still be member fa, boss the thing just weak me I dey post wella before but as I see say guy man no dey rank up for the forum I just relax, as I no dey receive merit the thing just weak me boss I will be glad if you share some places wey I fit dey post wey dem go dey see my post wella and give me this stuff to go up, this forum Don really help but he just get as he b with those top accounts their itk too much, and most of the signature stuff na big accounts he require