Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Merits 5 from 2 users
Re: Nigeria (Naija)
by
Adbitco
on 24/08/2022, 12:25:43 UTC
⭐ Merited by Ever-young (3) ,Halab (2)
Our politicians no get any stand na so dem dey support where food dey come from.

Of lately i come understand sometin from this our politician say na greed make dem keep our country for dis kind bad situation onto say na my party member go enta seat or na dis nd dat go rule, all dis tin be say make money follow dey flow into their pesina bag no be to even put their citizen for front but only their own. I com also discova say dem dey fear make powa no remove from dia hand as well, bicus if dem no get powa dem no fit tok anyhow for country so all the political party just dey struggle to those tin instead them go think develop dey country make e open eye like abroad dem dey inside just dey circle powa among dia selves dey share money. If you cough dem EFCC take follow you up to empty little ones wey you manage collect from dem, after which dem still circle again share dat small one dem take from you.

na belle dem day follow my broda.
So like dis me no too put eyes dia, only i get to do is to keep my PVC Safe and ready to vote right pesin to rule us.