I greet everybody here oh....As I Come across this board I don see plenty things wey many of una don accomplish. That na why I humble myself come una side as per senior men to learn from each and everyone of una. As of now I be smaller (brand new) so I wan make una help me grow for this forum make I no loose guard.
I dey ready to learn cos I really wan earn.😌
Ahbeg make una take me under una wings
You dey highly welcome shaddyblinkz. Here na our naija board, so just feel lyk say you dey home already. Anything wey you wan ask drop am here and our people here go help you answer your question. But as beginner wey you be com join dis forum, make you go through dis board well Beginners and Help “
https://bitcointalk.org/index.php?board=39.0” make you read the rules for posting for dis forum so dat you go dey more guided. You dey welcome once again.