Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria (Naija)
by
Davidvictorson
on 24/09/2022, 17:49:44 UTC
I greet everybody here oh....As I Come across this board I don see plenty things wey many of una don accomplish. That na why I humble myself come una side as per senior men to learn from each and everyone of una. As of now I be smaller (brand new) so I wan make una help me grow for this forum make I no loose guard.
I dey ready to learn cos I really wan earn.😌
Ahbeg make una take me under una wings
You dey very welcome to the forum. Dem tok say follow who know road and I dey tell you say as you dey follow our 001 you nor fit loss. See eh, you will like it here if you dey your lane for the forum, you must to see 10x growth. I nor go lie give you, sometime small discouragement fit enter your mind base on one or two things but make you nor reason am. Always they try link up with guys here make them yarn you their own story becasue na from there you go take draw strength from. I take God beg you NO Plagiarize o. If you copy copy anything add link to were you copy am from. Once again welcome.