I greet everybody here oh....As I Come across this board I don see plenty things wey many of una don accomplish. That na why I humble myself come una side as per senior men to learn from each and everyone of una. As of now I be smaller (brand new) so I wan make una help me grow for this forum make I no loose guard.
I dey ready to learn cos I really wan earn.😌
Ahbeg make una take me under una wings
You are welcome my brother thank God say you locate us,this forum na to dey read na e be your work for now,no rush post make sure say anything wet u won know u ask question. Life dey easy for here but you need to dey careful with the rules and regulations so that you no go fall for law. We be one so we dey for you anoda thing be say u go try dey active for easy recognition.