Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria (Naija)
by
GiftedMAN
on 27/09/2022, 09:57:28 UTC
I greet everybody here oh....As I Come across this board I don see plenty things wey many of una don accomplish. That na why I humble myself come una side as per senior men to learn from each and everyone of una. As of now I be smaller (brand new) so I wan make una help me grow for this forum make I no loose guard.
I dey ready to learn cos I really wan earn.😌
Ahbeg make una take me under una wings

I welcome you specially and I like the pattern wey you take come here, as e be say no be yesterday or today wey you enter forum I believe say you dom observe one or two rules wey dey guide us for forum and also here because knowing those things go help you so that you no go fall hands even as person wey just dey come. Apart from knowing the rules I go encourage you to read more and ask questions instead of responding to things wey you no really understand and lastly put eyes well for beginners and help so that you go feet learn and get answers wey you dey find faster. As you dom locate here wey we dey your growth no go waste time and as naija people no dey carry last you no go carry last too.