Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria (Naija)
by
Ripe_berry
on 04/10/2022, 12:23:35 UTC
My ppl una good afternoon, Abeg how una take see this matta. As fedral government do talk last time say dey wan ban our lovely kpomo wey dey make dead animals for soup dey brekete just because say dey wan make leather indusrty wake up from sleep. Now kpomo don dey cost for market. Meat & fish no gree make we touch am. How person go dey chop for food and nothing dey to whin teeth and the only better thin wey dey give joy as man dey chop nah des dead animal. Me i don tire (adulthood nah really scam).