New Topic: Weti u go do if u bcome di President of 9ja
We just dey blame blame our leaders say dem no do dis, dem no do dat. Dem promised say, dem go remove Poverty, Employment go plenty, everybody go, go to school, dem go pay old pipo, dem go send students go Abroad go study, dem go bring down di high cost of tins, dem go do fine fine roads, gud gud houses, there will be 24hrs light nd more to count". nd di pipo come dey happy nd vote am put. Now afta he win di election, di big pipo (godfathers) nd oda big politicians come dey say, make im no do di thins he promised di pipo, nd if he do dem go remove am thro court or any oda allegations.
nd now dat u don kno di cartel wey bi dem bi anoda problem wey u go face 4 ur govt. nd u wan do ur promises. So na weti u go do 2 do those tins?
nd also weti dey ur mind 2 do if na u be di president 4 we country?