Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria (Naija)
by
Maestro75
on 20/10/2022, 08:19:32 UTC
Na di onli day I cried without cane. Dat day was really sad 4 me. Dat is why I always said dat di problem we have in 9ja na di arm forces and di court. Wen States governors plus federal government do dat, human rights activists carry di mata go court, till date I never hear anything wey di court judgement outcome.

And some youths weh witnessed the whole thing still deh get mind deh support this APC government because of wetin them want to chop from the government. My prayers na make God reward everyone according to who them support for this election. People weh deh healthy and fit to walk they beg a man weh no fit stand on his own to lead them. No be juju be that?

Dat is why sometimes I dey tink if dis country divide sef me I go happy.

My brother na the best thing weh fit happen be that but those weh deh steal from government and the northern league no go want am because e no go favour them. Na south get natural resources pass and na where government deh take generate cash.