online screen resolution changer
WATER FOLLOW RUN AWAY FROM ME EYE'S THIS DAY TOO, MAKE THE SOULS OF THOSE FALLEN HERO'S REST IN THE BLESSED MEMORY Today make am completely 2 years already.
Na di onli day I cried without cane. Dat day was really sad 4 me. Dat is why I always said dat di problem we have in 9ja na di arm forces and di court. Wen States governors plus federal government do dat, human rights activists carry di mata go court, till date I never hear anything wey di court judgement outcome. Di day wen 9ja go beta na d day wen we citizens nd di gvt go practice di real democracy. Do u kno day when dis #endsars protest was going on, di northern youth was supporting di government. Dat is why sometimes I dey tink if dis country divide sef me I go happy. Because anoda wahala we dey face 4 dis country na di northern youth. I Kno sae some pipo wey protest 4 d endsars still dey prison. Early dis year, won of the endsars protesters gave birth in prison. Dat means, there r lot of them in di prisons.
God will release Dem dis month nd 4 dose day had died, may God received ur souls. 😭😭 Our past heroes must be remembered
Ifa remember dis day e dey comot sleep for ma eye. Dat day nai I no say we govment no kia for dem citizens. I no forget wia I watch wen pesin hold flag, soja still shoot am.
Na God go judge all we leaders wey dey hapi to hide the video of wetin hapin for lekki toll gate and if we Kno wetin good for us, make we all come out vote out dis pipo.