Make states deh control their resources but pay taxes to FG no go fit work because the north weh e deh benefit well well no go gree. And our own politicians for south no too get mouth to talk once them show them bribe money. Southern politicians deh too greedy and na him deh cause north to deh ride the rest of the country. North weh no too go school deh rule people weh go school. The thing deh make shame catch me.
Chairman e belike you no know wetin those northern state get for natural resources oh. No be only crude oil be national response there are multiple been hoard by those stake and anything wey make the country divide na dem go benefits pass and I no go surprise of them dey thief the crude dey store for them states.
Also no joke with any state wey be say na dem dey incharge of food oh, if dem cut am e go wey the country. Dem fit use that food as a source to generate income for themselves and if them put head for ground e go go well. But no because dem know say FG go dey give them free funds from sucking the South South so their farming dey limited.
Ahhh boss you no get joy ooo your POV just dey make me laugh. So you mean you go first ammend the constitution wey go stop you from staying more than 8 years abi? Anyway, dem say e dey easy to talk than to do. How you go take do better roads and stable electricity without funds? You think you go fit pay FG civil and public servants salary and still get enough money to do infrastructure from the taxes wey states go pay? E no dey possible.
Belike you no understand me, all man for demselve. Every state go take of e own people. Una go pay una workers una selves. Generate job etc. This wey people coming into office go sabi wetin dem dey come do and not those entering to come chop money. If you no get any innovation na ur people go use their hand chase you self.