While we focus on the forth coming general elections do we have to neglect the current situations of the country.
The main issues now has become election, how to we cope before the election, the present administration has always been lackluster in performing their duties but now it has even gotten worse.
Well, the issue be say, na bad government dey cause everything wey you list so and unlike before wey we dey solved dem one after the other, this tym around Nigeria dun wise up and dem wan solve the problem from the root wey be who go lead Nigeria. If we get am wrong this time again as we dey do before then come next four/eight years we go dey here to discuss this same issue you dey mention above. But when we get am right, then many issue go dey resolved and Nigeria go go forward. Now to the flood matter, we all know wetin dey cause am say na dam and the solution but our mumu government no go build that shock absorber dam wey Cameroon advice dem to build.
Naira currency inflation na because the country no dey productive but only consuming here and there. If a better government been enter, by now we for dun get many working refinery and dey run our own fuel production plus other goodies wey dey follow but no mumu government only know how to borrow money and flex, dey pay allowances for all the people wey join hand keep them for the top.