Post
Topic
Board Nigeria (Naija)
Re: Nigeria (Naija)
by
knowngunman
on 20/11/2022, 08:08:05 UTC
Yes. God has power over everything and everyone, nothing go happen, everyone go enter next year and enjoy the bull market. Dem say experience is di original teacher.

Although, na dis year I really involved myself in cryptocurrency, and enter wen do market was 42$ nd as of March be dat. Nd from April nai di market just dey come down till now, tai!! Di small experience wey I don get for dis crypto world e no dey easy at all. Di coins I bought now no way to sell nd hungry wan kill pesin here.

Well Dogecoin is also good but one thing I came to understand is that bitcoin in any how im come down nai still dey high pass in di crypto world. 1 Dogecoin even in dis bear market of Bitcoin can't compare to 1 BTC.
Na why dem dey call am cry-pto. Meaning you go cry sometimes before you go begin enjoy. But our people say na who give up na that person fuck up, so we no go give up. The kind lesson wey Luna teach me hmmmm I suppose don give up long ago but na weak person dey easily give up. The lesson make me stronger but my leg still dey shake up to now cux I no balance again. Your comparison wey dey last line, I no understand am sha... You dey really compare dogecoin with btc? Oh wrong na